Dear Parents,
Eh, let me yarn you small. You see this my pupil wey dey my class? She is Deaf just like me. But come and see how she dey read the board without a single mistake — all because of the sign language wey she sabi. That thing just touch my heart.
So, let me talk straight — you wey dey hide your Deaf child for house because you feel say sending them to school na waste of money and time… come closer… YOU ARE WRONG!
If you get pikin wey Deaf and you dey hide them like biscuit wey you no wan share, abeg stop am! Carry them out, give them chance. If you dey find school, enter my inbox make we talk. I no care if your child don big or small — the most important thing be say make them get small education wey go help them stand for life.
Being Deaf no be curse ooo. Things just happen. Look at me now — I am Deaf, but I dey here teaching, working, living well. Why? Because my parents no hide me. They push me go school, and today I dey use that education to help myself and others.
But some parents dey behave like say their Deaf child na bad luck or curse, like say na the pikin cause the matter by themselves. My dear parents, relax! See me here now — I am a proud Deaf person, nothing dey do me.
So I beg you, give your Deaf children better life. Send them to school. Plenty schools dey for them. And if you wan the best, abeg come check Christie Toby Inclusive Education Center — na there I dey polish pikin till dem sabi read and write well.
No hide them again ooo, because if I hear say you still lock them for house, I fit come knock your door myself. 😂 If you need direction or help, slide enter my DM. I go show you the way.
Remember, your Deaf child fit shine too — just give them chance!

Comments
Post a Comment