7 wowo Nigerian comedians









 Good day Ladies and Gentle men, Na Una Boy ooo Ogudu Akpos AKA Ogus Baba. How you today (una don chop today?) Well I want to use this medium to share some fun with you guys here, Thanks  for this opportunity to share my wonderful time with you here alone.

Back to business as we all know they say " Too much of talk is bad" Therefore; i will love to work with this Saying today.

Like this so eh forget talk give yo-yo plantain, Base on tradition, come to think of it, seriously, American Comedians are better than Nigerian Comedians, Una know say that one na big lie. Sha make that one no interrupt us. jor. Click to continue.


Ogus Baba
Why i talk like that? seriously if you see all these American comedians suit up you go like them but make Nigerian Comedian suit up heaven and earth you no go see difference, neva laugh o i no go too talk today because dem say na people wen get Big head and mouth dey talk people like my Brother Comedian Basket Mouth, No try am oo that guy fit talk from today till next generation.
Ask Basket Mouth
Ogus Baba :- Basket Mouth
Basket Mouth :- Eh!
Ogus Baba :- Shey dat tin wen i talk for up so na lie?
Basket Mouth:- For where who talk am say na lie? No be Lie oo I fit talk from today eh mstcheeew fit reach another world wen baba God go create sef.
Ogus Baba :- Hey stop it simple question Yes or No you won start put your own.
Ogus Baba Continue
So as we dey talk before that ugly boy interrupted. Come to think of it all American Comedians fine pass all Nigerian Comedians both female and male.. I Thank God say i no go talk too much as i have Photo backups for my talk. what i am trying to say is, which American Comedian you won use compare with Basket Mouth? As Basket mouth no dey make me rest of his Handsomeness and for my mind i dey laff am say, him wen be like monkey, Me sef wen manage handsome small, neva boost say i handsome, him wen be like monkey na him com dey make noise.
Compare List
I want you to do me a favour to compare this photos. lolz..
See as they wowo take Good look at Them what do you think?
Are Dey Not Ugly?

A.Y
By Far this is the most ugly person i have ever seen in this world no qualifications for him. We know him as father of big eye.
Imagine, One day like dis wen dem dey give news for Silver Bird Television (STV) Na e dem mention one program Say na A.Y Show hmm na my pet dey gist me so o as i come na i ask my pet say wetin dem just talk for STV now.,
My Pet :- Dem Say weda na one program wey dem dey do say na A.Y Show na dem show one guy with Big Eye Say na Him get d show
Ogus Baba :- Big Eye? I just knw say na dat wowo boy A.Y dem talk so..
Come to think of it this guy fit scare person for night with this his big eye oo.
Preference Of Wowo



Introduction To Wowo

Basket Mouth
Monkey o, I no know why dis guy dey appear for everything on my list,
Monkies :- Leave am o! na our father be dat o we call am Father of Monkies in Monkey Kingdom
Ogus Baba :- Abeg make una vex, him belong sef no difference among una selves carry am go.
Monkies :- Thank God Say u Know







I Go Dye
OMG! why you create dis kind people for this earth na dem no belong jor shu person go wowo so te fowl sef feel am imagine one day wen my guy dey buzz for street as him dey waka dey go so him non know say Fowls sef know say this guy wowo and dey start monking the guy o
Fowls:- See am, wen him wowo finish so who follow am dey waka so if na like dem Eddie murphy now we go dey run follow dey but God catch you ..
I Go Die :- No be una fault i no blame una na Baba God wen put me for dis condition
Fowls :- Lolz so him even get mouth to dey talk self. wowo boy.

Basic Of Wowo



Gordon's
Gordon's is the most ugly Human being i have ever seen... Make him no deceive una o if i tell you say Gordons wowo for everyting Him voice be like Goat own na e make am dey do like goat at times so no be him fault because na everytime him dey complain give baba God..
Servant Of Wowo


Seyi Law
This Guy is Cute to Wowoness hehe i like dis guy so tey only call me for fone say Ogus Baba i say Eh I no be like others wen no fine but dem dey form say dem fine... Som times sef if i look mirror e go be like say make i vex break the mirror... Abeg I no fine jor
Chief Wowo








Omo Baba
See war b4 i won forget King of wowo A.K.A Omo Baba. This guy wowo so te wen baba God dey create am.. Lolz Guess What? Baba God Tire for him Creation lolz dis guy over wowo.. I present To you The King Of Wowo
King Of Wowo



Ogus Baba
Na me fine pass self.. check me out.
Handsome Guy

Comments